WHO WAN DIE?
_
Police: Paaarrk! Wey ur particulars?
-
Me: Here they are.
-
Police: They are incomplete.
-
Me: Check them well, they are complete
-
Police: Do you want to teach me my work? By the way where you dey come from by this time of the night?
-
Me: I go burial
-
Police: Who die?
-
Me: Na one Policeman
-
Police: Wetin kill am?
-
Me: He collect juju money from one driver for check point and him hand come swell he come die.
-
Police: Na your friend?
-
Me: No
-
Police : Your relation?
-
Me: No
-
Police: Wetin you come go do for the burial?
-
Me: I go remove the money from the dead man hand.
-
Police: Wetin concern you for the matter
-
Me: Na me be the native doctor wey do the juju
(The policeman was staring at me now)
-
Me: Oga police, I beg I don tire, make I find you something make u let me dey go.
-
Police: Police is your friend, we no dey collect bribe again. Have a nice day.
-
Me: Thank you same to you.
-
Don't laugh alone Comment below
Post a Comment